Saturday, 12 March 2016

JOKES OF THE DAY part 1

1. You see identical twins, you still dey ask 'na twins be dis'?
No bros, na picmix...

2. Nepa brings light and everyone in the neighbourhood shouts 'up Nepaaa'!
My guy ask me, O boy na light be that?
No oh, Na Holy Ghost fire!.

3. You see person dey vomit, you still dey ask am'you no well'?
Em well, e just dey practice how to vomit..

4. You just wake up from sleep person come ask you "you don wake?"
No oh, I come buy bread wey I go chop for dream..

5. You see woman wey born new pikin u ask her"madam u don born? " No ohhhh, she buy am for OLX....

6. You greet person "good morning ma" ! She ask, my pikin you don wake????
no ohhhh, I dey sleep walk....

7. My guy ask me "O boy where u dey?" I tell am say i dey bank, and him ask me "Wat is happening there?"
Nah new yam festival...

8. My neighbour sees me opening the gates to drive out and asks me, U dey comot?
Not at all... I be the new gate man....

9. I dey watch film… my guy enter come ask me"Guy na film u dey watch?
No naa... I dey discuss with Osuofia....

10.U see me dey chop indomie come dey ask me, O boy, na indomie u dey chop so?
No ohhhh... Na fried rubber band mixed with thread..

Don't forget to invite your friends to this great information Passer........ Just chibytic in nature., faster than assumption and accurate as an electrical device #I love you all

No comments:

Post a Comment

Live Stream: Rhapsody Online Prayer Conference 2020

The great day has finally come as you can now stream Rhapsody Online Prayer Conference 2020.  Watch the live conference below and remain bl...